Ini Edo
Iniobong Edo Ekim (dem bon am for April 23, 1982) na Naijá aktres. Ini Edo stat e fim karia for 2000 an e don akt for more dan 100 muvi-dem sins e stat to akt. For 2013, Ini Edo bí joj for di Miss Black Africa UK Pageant. For 2014, United Nations chuz miss Ini Edo as United Nations Habitat Youth Envoy.
Tori of e life an skul way e go
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ini Edo na Ibibio wuman fom Akwa Ibom stet for south-south pat of Naijá, nia Calabar. E mama na skul tisha, and e papa na choch elda. Ini Edo bi sekond pikin out of four pinkin-dem wey e mama an papa bon, dem bi three gels one boi. Na strong hand dey yuz train Ini Edo. E go Cornelia Connely College for Uyo, Naijá . Ini Edo go University of Uyo wia e get Diploma for Theatre Arts. Ini Edo get bachelo digri fom University of Calabar wia e rid Inglish. For 2014, e get skularship to rid law for National Open University of Nigeria.
How e tek wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]The first movie wey shi akt na Thick Madam for 2003. Na one producer dicover Ini Edo wen she go for audition. Ini Edo blow for 2004 when she akt for the movie 'World Apart'. She don akt for more dan 100 film-dem. Dem give her "Best Lead Actress" nomination for di 11th Africa Movie Academy Awards for ha performance for di movie "While you slept".
For 2017, Ini Edo talk sey na only hardwork, delight an dedication fit helep persin succeed for Nollywood industry bikos plenty-distraction dey.
E pasona life
[chenj-am | chenj-am for orijin]For 2008, Ini Edo mari Philip Ehiagwina wey bi American-based bizines man. Di marej skata for Septemba 2014, afta six years. Ini Edo get e fest pikin wey bi girl by anoda wuman wey hep am kari di bele for 2021.
For April 2023, Ini Edo bin tok say di tori of ha rileshonship wit felow aktres Empress Njamah's bifor boyfriend, George Wade, na jos rumor and e nor be true.[1]
Endorsement wey e du
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ini Edo don bi GLO brand ambasado for ten years from 2006 go rich 2016. For 2010, Ini Edo bi di brand ambasado for Noble Hair. Ini Edo na brand ambasado for Slim Tea Nigeria. For 2019 dem mek Ini Edo ambasado for di @MrTaxi_NG brand.
How e tek wok for politis
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem mek Ini Edo Speshal Asistant to di Akwa Ibom Stet Govno for Culture and Tourism for 2016.
Awods an nominashon
[chenj-am | chenj-am for orijin]Year | Event | Prize | Pesin wey kolet am | Resot | Ref |
---|---|---|---|---|---|
2009 | 2009 Best of Nollywood Awards]] | Best Actress Leading Role (Yoruba) | won | ||
2011 | Zulu African Film Academy Awards | Best Actress Indigenous | Edika Nigeria | won | |
2012 | 2012 Golden Icons Academy Movie Awards | Best Actress In Leading role | In a cupboard | nom | |
Female Viewers Choice | Herself | nom | |||
Honorarium Appreciation Award | won | ||||
2013 | 2013 Golden Icons Academy Movie Awards | Female Viewers Choice | won | ||
Cross River Movie Award | Best Act Female(English) | Behind The Melody | won | ||
Nafca | Best supporting Actress | Weekend Getaway | won | ||
2014 | 2014 Golden Icons Academy Movie Awards | Best Actress Leading Role | Nkasi The Village Fighter | nom | |
Best Comedic act | nom | ||||
Best Actress-Viewers Choice | nom | ||||
2015 | 2015 Golden Icons Academy Movie Awards | Best Actress | While you slept | nom | |
Female Viewers Choice | nom | ||||
2015 Ghana Movie Awards]] | Best Actress - Africa Collaboration | won | |||
11th Africa Movie Academy Awards]] | Best Actress Leading Role | nom | |||
2016 | 2016 Africa Magic Viewers Choice Awards | Best Actress in a Comedy | Desperate housegirls | nom | |
2016 Nigeria Entertainment Awards | Best Actress - TV Series | nom | |||
2018 | ZAFAA Global Awards | Best Actress | While you slept | won | |
2021 | Net Honours | Most Popular Actress | nom | ||
Africa Movie Academy Awards | Best Actress in a Supporting Role]] | The Citation]] | nom |
Wie dem gada di tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ Ogedegbe, Isaiah (27 April 2023). "Ini Edo Debunks Rumours Of Her Affair With Empress Njamah's Ex-Boyfriend". Opinion Nigeria. Retrieved 10 May 2023.